30 I dey near am like pesin wey dey design house before dem build am. Na mi dey make am happy evriday and I dey happy for en present.
God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.
As e still dey tok, one brite kloud kon kover dem and one vois kon sey, “Dis na my Pikin wey I love. Make una listin to am!”
Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”
Nobody don fit si God face before. But Jesus, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait friend, na-im kom show us how God bi.
Papa, make yu honor yor name.” Den one vois tok from heaven sey, “I don honor am before and I go honor am again.”
Na my Papa send mi kom dis world, but naw, I dey go back go meet am.”
E save us from darkness pawa and put us for di kingdom wey E give di pikin wey E love.