Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.
“God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.
Bikos di Papa get strong love for en pikin, e dey always show am evritin wey e dey do and e go show am plenty tins wey pass dis one and una go sopraiz.