For di eight years wen e dey rule, even doh e still dey yong, e start to serve God wey en grand-grand papa David serve. For di twelft year, e bigin distroy all di place where dem for dey serve juju: Asherah juju and all di oda juju.
As I waka pass dem small, I kon si di pesin wey I love. I hold am tight and I nor wont make e go, so I take am go my mama house; to di bedroom where e for get my belle.
I nor dey tok for sekret or for di dark place for di eart. I neva ever sey, ‘Jakob shidren just dey follow mi for nor-tin.’ Mi wey bi God dey tok di trut. Yes! I dey tok wetin dey rite.”
But wen Jesus si wetin dey happen, e vex kon tell en disciples, “Make una allow small-small shidren kom meet mi, nor stop dem, bikos na pipol like dem, go enter God Kingdom.
“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!