14 Kommon sense and suksess na my own. Na mi get undastandin and pawa.
But God get wisdom and pawa. E know and undastand many tins.
Una nor gri take my advise or allow mi korrect una.
Pipol wey nor kare about odas, dey tink only about demsef; so dem nor go gri take korreshon from oda pipol.
If yu dey listin to advise and dey ready to learn, yu go wise one day.
To dey wise, betta pass to dey strong! Yes, wisdom betta pass pawa.
So my pikin, whole di wisdom and undastandin wey yu get well and yu nor ever let dem live yu.
Pesin wey wise, strong pass ten pipol wey dey rule di town,
All dis wisdom dey kom from God wey dey lead heaven sojas. Na-im dey give pipol wisdom and dey guide us for evritin wey wi dey do.
Who God dey go ask make E for fit undastand how E go do tins?
Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”
Yu dey make betta plan kon do mighty tins. Yu know evritin wey pipol dey do and Yu dey reward dem akordin to wetin dem do.
Na Jesus bi di true lite wey go shine for evribody for dis world.
Even doh dem tink sey dem wise, dem bi fools;
But for wi wey God don koll, weda wi bi Jew or Greek; na Christ bi God pawa and wisdom wey save us.
Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;
Bikos all di wisdom and knowledge wey God get, E hide dem inside Christ.