Na one woman from Naftali wey en husband don die, born am and en papa na kraft man wey bin dey work with bronze for Tyre. E get wisdom to take make any kind tin with bronze. E go meet King Solomon kon do all di work wey dem gi-am.
E still gi-am di plan, just as e get am for mind to build di kourtyard and di rooms wey round dem; di store room wey dem go put di temple tins and di gifts wey dem dedikate give God.
E make dem undastand, so dat thru di church, all di rulers and pawas wey dey heaven go kon know God komplete wisdom, wey dey show ensef for difren ways.