Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 7:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 My pikin, make yu remember wetin I dey tok; nor forget wetin I sey make yu do.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 7:1
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make yu follow di tins wey E dey tish kon keep en words for yor heart.


My pikin, make yu listin wen yor papa dey korrect yu and follow wetin yor mama dey tish yu,


Wise pipol dey kollect all di wisdom wey dem fit get, but wen yu hear foolish pipol dey tok, yu go know sey trobol nor dey far from dem.


My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do.


Nor ever let dis words leave yu, remember and protet dem with yor heart.


Di woman go take yu go where dead body dey, bikos dat road dey lead to deat.


My pikin, make yu do wetin yor papa tell yu and nor ever forget wetin yor mama tish yu.


E nor go gri take any money and no amount of gift go stop en vexnashon.


Den Jesus sey, “Pipol wey hear God word and do wetin e tok, na dem God don bless!”


But di seeds wey fall for betta groun, na di pipol wey hear God word, hold am with betta mind, dey obey God and bear wahala, so dem kon bear plenty fruit.”


Jesus ansa am, “Anybody wey love mi, go do wetin I tok and my Papa go love am, den wi go kon meet and stay with am.


Make una remember wetin I tell una, ‘Savant nor dey big pass en oga.’ If dem sofa mi, den dem go sofa una too. If to sey dem obey my word, dem go obey una own too.


But na curse bi una own, if una rijet di Oga una God kommand kon turn from am go woship oda gods wey una nor know before.


Di pesin wey go read dis profesy give pipol, God go bless am. God go bless doz wey dey listin and do wetin dem rite for di profesy, bikos di time don near.


But e tell mi, “Nor do like dat! I bi savant like yu, like yor brodas di profets and doz wey go obey di words wey dey dis book. So make wi woship only God!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ