Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 6:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Lazy pipol, make una learn lesin from di way ant dey live dia life.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 6:6
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E nor dey good to set trap wen di bird wey yu won katch dey look yu.


Nor allow lazy pesin work for yu, bikos e go bi like betta wine for yor mout or like smoke wey enter yor eye.


Lazines go make yu poor, but hard work go make yu get money well-well.


Lazy pipol won get plenty, but na small dem dey get, while doz wey dey work hard, dey prosper.


If yu dey lazy, tins nor go eazy for yu, but if yu dey do wetin dey rite, trobol go dey far from yu.


Lazy pesin bad like pesin wey dey distroy tins.


If yu like, dey lazy and dey sleep anyhow, but make yu know sey honga go soon kom kill yu.


Some pipol too lazy to put food for dia own mout.


Farmer wey lazy well-well to klear en farm for di rite time, nor go get anytin to harvest.


Lazy pipol wey nor gri work dey kill demsef and


Lazy pipol dey always sey, “Lion dey outside and e go kill us”, so dem nor go gri go out.


Listin my pikin; make yu get sense and tink how yu dey live yor life.


“E get four tins for eart wey small, but dem wise well-well and dem bi:


“ ‘Ants; dem nor strong, but dem dey keep food wait dry sizin.


But na how long lazy man go take dey liedan for en bed? Wen e go ever get up?


Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food, but Israel wey bi my pipol nor know or undastand mi at-all.”


Just as bird for sky know wen to fly, na so too, dove, swallow and crane know wen to shange pozishon. But my pipol nor gri do wetin mi, wey bi God sey make dem do.


“En oga kon tell am, ‘Yu wiked and lazy savant! Since yu know sey I dey harvest wetin I nor plant and dey pak fruits wey I nor plok,


Make una look di birds wey dey fly for sky, dem nor dey plant or put anytin wey dem gada inside store, but una Papa for heaven dey feed dem. Una nor betta pass dem?


Make una nor taya, but with di Holy Spirit help, make una serve God with betta mind.


So make any of una nor taya, but make una dey patient and bilive, so dat una go gain God promise.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ