22 Wetin dem tish yu so, go lead yu wen yu dey waka, protet yu for nite kon give yu good advise for day time.
I don keep yor word for my heart, so dat I nor go sin against Yu.
I nor dey sleep for nite, bikos I dey tink about yor promise.
bikos yor law dey sweet and dem dey give mi good advise.
Anywhere wey I dey, na yor law bi di song wey I dey sing.
Di only way yong pesin go if live betta life, na to obey God word.
My God, si as I love yor laws and I dey tink about dem evriday.
I don follow yor kommand wey nor let mi follow wiked and bad pipol.
I nor dey fear, even doh doz wey dey attack mi from evry korna, plenty well-well.
Make Yu send yor lite and trut kon guide mi. Make dem karry mi go yor holy mountin, di place wey Yu dey stay.
Di sense and undastandin wey yu go get, go protet yu.