20 My pikin, make yu do wetin yor papa tell yu and nor ever forget wetin yor mama tish yu.
Listin to yor papa; bikos without am, yu nor go dey dis world and wen yor mama don old, make yu still dey respet am.
“Some pipol dey curse dia papa and some nor dey tank dia mama.
My pikin, make yu listin to my wisdom and put yor ear down for di words wey I dey tish yu.
Di woman go take yu go where dead body dey, bikos dat road dey lead to deat.
and I si many men wey nor get sense, but I notis one among dem wey foolish well-well.
“So wi, awa wifes, sons and dotas dey obey wetin awa grand-grand papa, Jehonadab kommand us and since den, wi neva drink wine;
Shidren, as una know God, make una dey hear una papa and mama word, bikos na wetin una suppose do bi dat.
If pesin get sturbon son wey nor dey listin to en papa and mama even doh dem ponish am,
Anybody wey nor respet en papa and mama, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”