Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 6:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Na bad plans full dia heart and na so-so trobol dem dey kause.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 6:14
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

doz wey dey plan evil for dia heart and dey kause trobol waka.


Dia tongue dey wound pipol like snake and dia lips dey bring out snake poizin.


Instead of dem to dey sleep for nite, na bad tins dem dey plan. Wetin dem dey do nor dey good. Dem nor even dey try to turn from dia wiked ways.


If yu plan to do bad, yu go lost; but if yu plan to do good, yu go get love and faithfulnes wey nor dey fail.


Wiked pipol dey always look for how to wound odas; even wetin dem dey tok fit burn and kill pesin like fire.


Make doz wey dey tink and tok bad-bad tins nor espect any good tin escept trobol.


and dem dey happy to do yeye and wiked tins.


Bad belle pipol nor gri do wetin dey rite; but innocent pipol dey do wetin dey good.


Pesin wey like wikedness, na trobol go bi en own and en wahala against oda pipol, go soon end.


If yu dey always plan evil, na trobol-maker dem go dey koll yu,


Nor ever plan bad against yor neighbour, bikos doz wey dey stay near yu, trust yu.


bikos God hate pipol wey dey do evil, but E dey draw raitious pipol near body.


Na so-so wiked tins pipol wey dey deceive odas dey tink and na di wiked tins wey dem won do to poor pipol, dem dey always dream about, even wen di poor pipol dey do wetin dey rite.


But wiked pipol bi like sea wey dey make nois anyhow; en wave nor dey finish and na so-so dirty e dey bring.


So God tell mi, “Dis men dey plan evil and na wiked advise dem dey give Jerusalem pipol.


Wen una plant breeze, una go harvest heavy rain. Una korn nor go produce bread. Even if e produce, na strenjas go chop am.


E go bad for doz wey nor dey sleep for nite, bikos of di bad tins wey dem dey tink and plan to do. For early morning, dem go rush go do wetin dem plan, bikos dem get pawa to do am.


Naw, my brodas and sistas, I dey beg una, make una know di pipol wey dey kause wahala and oppoz di tishing wey una don learn from us. Den make una nor go near dem!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ