11 But as e dey sleep, evritin wey e get go vanish like sey na tif karry dem go.
Lazines go make yu poor, but hard work go make yu get money well-well.
Lazy pipol won get plenty, but na small dem dey get, while doz wey dey work hard, dey prosper.
If yu like, dey lazy and dey sleep anyhow, but make yu know sey honga go soon kom kill yu.
If na so-so sleep yu dey sleep, na poverty go kill yu. But if yu dey work hard, yu go get plenty food to chop.
Farmer wey lazy well-well to klear en farm for di rite time, nor go get anytin to harvest.
bikos pipol wey dey drink and chop too mush, go soon luz evritin. So, If all wetin yu dey do na to dey chop and sleep, den yu go soon start to wear rag.
Make yu sleep and rest as yu like or fold yor hand and rest small,
but make yu remember sey, as yu dey sleep, poverty go kom attack yu like tif.
Foolish pesin dey fold en hand and nor dey work, so e nor get anytin to chop, escept en own flesh.