9 If yu follow am, nobody go respet yu again and strenjas go take evritin wey yu get.
I still tell dem, “Na wimen from anoda kountry make King Solomon sin. Dis man great pass any of di king for oda nashons. God love am kon make am king ova Israel pipol, yet e still kommit sin.
make yu nor waste yor strent dey follow wimen; bikos dem dey distroy kings.
Yes! Strenjas go take all yor propaty and anoda pesin go kollect evritin wey yu work for.
Run from dat kind woman; nor even go near en door.
Bikos to sleep with ashawo fit make man poor, but to sleep with anoda man wife go make yu luz yor life.