7 But my pikin, make yu listin to mi and nor forget wetin I dey tok.
I neva sin against yor laws, bikos Yu tish mi well.
So my pikin, whole di wisdom and undastandin wey yu get well and yu nor ever let dem live yu.
My pikin, make yu listin to wetin yor papa dey tish yu; put yor ear down and yu go undastand.
Nor ever let dis words leave yu, remember and protet dem with yor heart.
So naw, my pikin, make yu listin and hear wetin I dey tok.
Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?