6 Di woman nor dey tink about di road wey dey save; e dey waka lost but e nor know.
Wen I tink as my life bi naw, I kon choose to follow yor ways.
Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.
Anybody wey ready to live rite, go get life; but pesin wey sey na bad tins e like to dey do, go die.
Nobody wey go visit am, dey kom back alive. True-true, e nor go ever kom back to life again.
“Ashawo woman wey sleep with anoda man fit kill pesin, afta e go klean en mout kon sey, ‘Na wish bad tin I do?’
Anytin wey yu won do, make yu plan am well, den evritin wey yu do go dey okay.
God dey si evritin wey yu dey do and E know evriwhere wey yu dey go.
Foolishness bi like woman wey nor know anytin at-all, nor get shame at-all and wey dey tok anyhow.
Wetin dem like pass, na to sleep with who dem nor marry; dem nor dey taya to sin and dem dey draw doz wey dia faith nor strong, follow body. Dem don train dia mind to get long-trot and God don curse dem.