19 bikos e fine and dey honbol like deer. Make en smile dey make yu happy and make en love satisfy yu.
“But one day, di rish man get visitor for en house. E nor won kill en own animal take kook for di visitor, instead e go take di poor man sheep take kook for dem.”
Just as yu go take wota from yor own well, na so too make yu dey faithful and love only yor wife.
My pikin, why yu go-go give yor love to anoda woman? Wetin make yu like di way anoda man wife bi?
My love, before di morning breeze go blow and darkness go disappear, make yu kom back kom meet mi like gazelle or yong deer wey dey on-top mountin.
My love bi like gazelle or yong deer. Look! E stand for back of awa wall, where e for dey look di room thru di window.
Yor two breast bi like gazelle or deer wey bi twins wey dey chop for where lily flower dey.
Yor two breast bi like gazelle or deer wey bi twins.
My love, make yu kwik kom meet mi like gazelle or yong deer wey dey on-top di mountin where spices for dey grow.