8 Love wisdom and e go make yu great; draw am near body and e go bring respet for yu.
If yu obey God kon honbol yorsef, yu go get propaty, honor and long life.
E go give yu long life, plenty propaty and honor.
Pipol wey wise go get good name, but fools go only add trobol join dia disgrace.
E dey rub my head with en left hand kon dey massage mi with en rite hand.
But wise pipol go shine like lite for di sky. Doz wey tish pipol di rite tin, go shine like star forever and ever.
“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!