Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 4:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 my papa go tell mi, “Make yu always remember wetin I tish yu. Do wetin I tok and yu go get long life.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 4:4
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I don choose am, so dat e go kommand en son and shidren-shidren sey make dem obey mi kon do wetin dey good and korrect. If dem obey mi, I go do evritin wey I promise am.”


Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.


I don keep yor word for my heart, so dat I nor go sin against Yu.


Yor laws always dey rite; so make Yu help mi undastand dem, so dat I nor go die.


Yes, I dey obey yor kommandment and yor laws, bikos Yu know evritin wey I dey do.


Make yu tish yor pikin how e go take live en life and wen e don old, e go still dey do di same tin.


My pikin, listin well-well and make my life bi ezample to yu.


My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do.


Wetin I tish yu go make yu prosper and get long life.


Do wetin I tok and yu go get good life! Protet all wetin I tish yu just as yu go protet yor eye.


My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.


So I kon tell am, “E nor go give yu to dem. I dey beg yu make yu listin to God message, den evritin go-go well for yu and dem nor go kill yu.


I know sey anytin wey God kommand, dey give life wey nor dey end, so I dey tok wetin E send mi.”


Una wey bi papa, make una nor make una shidren vex, but make una raiz dem to follow Christ tishing.


But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.


Dis word wey I dey kommand una about today so, una must keep am for una mind


I always dey remember di faith wey yu first get from yor grand-mama, Lois and from yor mama, Eunice. I dey sure sey e dey inside yu.


Dem don tish yu God word since yu bi small pikin and yu don get salvashon to receive di wisdom wey dey kom thru Christ, wey yu trust.


Wen God don make Christ pafet finish, e kon save evribody wey obey am.


Den Manoah sey, “If wetin yu tok so happen, wish kind tins di boy go dey do and wish kind life e go live?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ