27 Make yu run from bad tins kon waka for strait road, so dat yu nor go turn go left or rite.
My pikin, make yu nor follow dat kind pipol or go near dem at-all.
Doz wey good nor dey travel pass bad road; so look where yu dey go, bikos e fit save or distroy yor life.
Make una go wosh unasef klean and stop all di evil tins wey una dey do.
Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.
So all dis kommand wey I dey give una so, make una obey dem with kare. Make una nor add join or remove from dem.
Make una nor turn from any of dis kommand wey I dey give una today or go follow and woship oda gods.
So make una dey kareful kon do as di Oga una God kommand; make una nor turn go rite or left!
Make sure sey yu dey strong well-well and yu get heart! Make yu dey obey all di law and kommand wey my savant Moses give yu! Nor do dem anyhow, den yu go prosper for evritin wey yu dey do.