Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 4:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Anytin wey yu won do, make yu plan am well, den evritin wey yu do go dey okay.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 4:26
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

If to sey I fit live my life just as Yu tok


Wen I tink as my life bi naw, I kon choose to follow yor ways.


God dey lead doz wey dey fear am. E dey-dey happy with evritin wey koncern dia life.


E take mi komot from di pit where shame, pain and sofa full kon put my leg for groun wey strong well-well, den E make mi strong as I dey waka.


Foolishness dey make doz wey nor get sense happy; but pesin wey get sense, dey always do di rite tin.


Good pipol dey-dey sure of demsef; but wiked pipol sabi pritend well-well.


Listin my pikin; make yu get sense and tink how yu dey live yor life.


Make yu look strait and nor bow yor head, bikos yu dey shame.


God dey si evritin wey yu dey do and E know evriwhere wey yu dey go.


Di woman nor dey tink about di road wey dey save; e dey waka lost but e nor know.


bikos e si sey wetin e dey do nor good, so e kon stop to dey sin. E nor go die at-all, but e go live.


Naw dis na wetin Oga God wey get pawa dey tok: “Make una tink about wetin dey happen to una!


“God wey get pawa sey, ‘Make una tink about wetin dey happen to una naw.’


Make una dey kareful as una dey live una life. Make una nor bi like pipol wey nor get sense.


Bikos of dis, make una get sense to undastand wetin awa Oga God word tok and mean.


so dat una heart go dey strong for holiness. And for di time wey Christ go kom with en pipol, una go dey without fault for God present.


But Christ dey keep en promise and E go make una strong.


And make una waka for strait road, so dat una leg wey don taya, go strong.


Afta una don sofa small, God wey koll una with en grace enter en glory for Christ, go make una komplete, una leg go strong and una go get pawa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ