25 Make yu look strait and nor bow yor head, bikos yu dey shame.
“I don swear with my eye sey I nor go ever look wimen kon sey I won sleep with dem.
Make Yu help mi take my eyes komot from tins wey nor mean anytin and give mi life thru yor word.
Foolishness dey make doz wey nor get sense happy; but pesin wey get sense, dey always do di rite tin.
Good pipol dey-dey sure of demsef; but wiked pipol sabi pritend well-well.
Yor eyes go si tins wey go sopraiz yu and yu nor go fit tink or tok well.
bikos yor money fit finish wons like sey e get feada kon fly leave yu like eagle.
Nor ever lie. Nor do anytin with pipol wey dey lie or tok bad words.
Anytin wey yu won do, make yu plan am well, den evritin wey yu do go dey okay.
“Na eye bi di lite for pesin body. If pesin eye dey okay, lite go full en body.