24 Nor ever lie. Nor do anytin with pipol wey dey lie or tok bad words.
If yu dey hide do wiked and bad tins, make yu stop am.
Make yu turn from wiked tins kon do wetin dey good. Make yu dey leave for peace with evribody and do evritin to keep am like dat.
If yu obey God, yu go always know di rite words to tok. But nobody go trust yu if yu always dey lie.
Make doz wey dey tink and tok bad-bad tins nor espect any good tin escept trobol.
E betta make pesin dey poor and get good karata, dan make e bi fool wey nor get trut for mout.
Make yu look strait and nor bow yor head, bikos yu dey shame.
Wetin yuzles and wiked pipol bi like? Na lie dem just dey lie waka.
If to sey una dey fear God, den una go hate bad tins. I hate pride, pipol wey dey tok anyhow, bad-bad tins and lie-lie words.
Evritin wey I tok na true; I nor dey lie or dey lead una go die.
Make una stop all di bad and wiked tins wey una dey do, so dat una go get new mind and heart. Israel pipol, why una like to die?
but naw, to dey vex anyhow; to get bad mind for pesin; to take mout spoil pesin and to dey curse pipol, make una remove dem from una life.
and wahala, naim e dey kause. Dia mind don spoil and dem nor know di trut again, bikos dem tink sey dem fit use God work take make money.
So make una remove una hand from evry dirty and wiked tins kon put una body down to asept God word wey dem don plant inside una, bikos e get pawa to save una soul.
If anybody tink sey en dey follow wetin wi dey tish and e nor fit kontrol en mout, dat pesin dey deceive ensef and en relijon nor mean anytin.
Make una stop to do bad tin; dey deceive pipol, pritend; dey jealous and tok bad about pipol.