22 Bikos dem dey give life and betta body to anybody wey undastand dem.
Foolish pipol dey tok anyhow, but wetin wise pipol tok, dey heal many wound.
Good words bi like honey; e dey sweet di soul kon make body strong.
Dem go make yu live sweet and happy life. Dem go bi like betta shain for yor neck.
If yu do like dis, yor body go dey okay and yor bones go strong well-well.
So my pikin! Make yu listin to mi; make yu take evritin wey I dey tell yu sirious, den yu go get long life.
my papa go tell mi, “Make yu always remember wetin I tish yu. Do wetin I tok and yu go get long life.
Doz wey find mi, go get life and God go favor dem.
But I go heal di town and en pipol kon make dem well again. I go give dem peace forever and dem go dey save.