Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 4:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Remember evritin wey I dey tish yu, bikos dem dey good.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 4:2
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.


But if yor pipol turn from mi kon dey disobey di rules and kommand wey I sey make dem keep and dem kon dey serve anoda god,


Yu sey, ‘My tishing dey pure and I dey klean for God eye.’


All my words na true and na true I go tok.


Even doh dem don nearly kill mi, I still dey obey yor kommands.


My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do.


“So wi, awa wifes, sons and dotas dey obey wetin awa grand-grand papa, Jehonadab kommand us and since den, wi neva drink wine;


Make wetin I dey tish una, fall on-top una like rain; make wetin I dey tok bi like dew for morning. Make my words fall like rain on-top grass and make e bi like shawa on-top plant wey just dey grow.


If yu give all dis kommand to di brodas and sistas, yu go bi good savant for Christ, bikos yu don feed yorsef with God word, wey bi di spiritual food and naim bi di good tishing wey yu dey follow.


E must bilive di message about God wey e dey tish, so dat e go fit tell pipol di trut and korrect doz wey dey oppoz am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ