Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 4:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 But wiked pipol road dark well-well; dem go fall and dem nor go si wetin make dem fall.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 4:19
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem dey waka find road for darkness. E make dem stagga like man wey don drink well-well.


Dem go porshu dem from where pipol stay kon still porshu dem from lite enter darkness.


Dem dey waka for darkness for day time. For aftanoon, dem dey waka dey find road like sey dem dey darkness.


But doz wey dey opress oda pipol, nor know anytin at-all. Dem bi fools! Dem dey waka anyhow for darkness, while all di foundashon for di eart dey skata.


From pipol wey live good life before dem bigin do bad-bad tins;


Trobol and wahala dey where wiked pipol dey waka pass, but wise pipol wey sabi guide dia soul, dey-dey far from dem.


Make una respet di Oga una God, before E go bring darkness wey go make una kick stone fall on-top mountins! Make una respet am, before E go turn una lite to darkness.


So di road wey dem dey pass, go dark and go dey draw; I go make dem kick stone fall. I go bring wahala kom meet dem and di time to ponish dem, don near. Mi, wey bi God, don tok.”


Make una leave dem! Dem bi blind pipol wey dey show blind pipol road. If pesin wey blind dey show anoda blind pesin road, two of dem go fall inside gutta.”


Dat time, I go sey, ‘I nor know yu. Make yu komot from where I dey, yu wey wiked well-well.’ ”


But pesin wey waka for nite, go fit fall, bikos e nor get lite to si road.”


Jesus ansa dem, “My lite nor go dey with una tey. Naw wen di lite dey, make una take am waka, so dat darkness nor go kover una. Bikos di pesin wey dey waka for darkness, nor dey si where e dey go.


But di one wey hate en broda or sista for Christ, dey for darkness and e nor know where e dey go, bikos darkness don blind en eye.


E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ