12 Nor-tin go stand for yor way if yu dey live wise life, den yu nor go fall wen yu dey run.
Yu keep mi, so dat dem nor go katch mi and I nor fall.
Pipol wey love wetin Yu tok, get peace of mind and dem nor dey fear, shake or fall.
I go dey save, bikos na only yor kommand I dey follow.
Yu don make betta road for mi, so dat I nor go draw fall.
So, if yu listin to wetin I dey tok; yu go know wetin dey rite, true and korrect, den kon know wetin yu suppose do.
Dem go make yu dey save for anytin wey yu dey do and yu nor go ever fall.
But wiked pipol road dark well-well; dem go fall and dem nor go si wetin make dem fall.
Wetin dem tish yu so, go lead yu wen yu dey waka, protet yu for nite kon give yu good advise for day time.
As I dey lead dem kom back, dem go dey kry, beg and pray make I forgive dem. I go guide dem pass where wota dey kon take dem pass strait road where dem nor go kick stone fall. I go do am, bikos na mi bi Israel papa and Efraim na my first-born.’ ”
Na-im bi di rock wey dey fall pipol, bikos dem nor fit jump am pass. As dem nor bilive God word, dem bigin fall, bikos na so E plan sey e go bi.