1 My pikin, make yu listin to wetin yor papa dey tish yu; put yor ear down and yu go undastand.
“Make una listin to mi, una wey bi Jakob shidren; make una listin to Israel wey bi una papa.
My shidren, make una kom listin to mi and I go tish una how to fear God.
E rite dem so dat pipol go get wisdom, undastandin and good advise.
My pikin, make yu listin wen yor papa dey korrect yu and follow wetin yor mama dey tish yu,
Pikin wey get sense dey listin to en papa and mama word, but doz wey dey foolish, nor dey take korreshon.
If yu dey listin to advise and dey ready to learn, yu go wise one day.
Make yu listin and I go tish yu wetin wise pipol tok and as yu undastand wetin dem tok,
My pikin, make yu listin to my wisdom and put yor ear down for di words wey I dey tish yu.
Trit wisdom like yor sista and undastandin like yor best friend.
“So wi, awa wifes, sons and dotas dey obey wetin awa grand-grand papa, Jehonadab kommand us and since den, wi neva drink wine;
Make wi listin to wetin wi don hear, so dat wi nor go fall komot from di rite road.