7 So allow dem drink forget dia poverty and dem nor go remember dia trobol again.
Dat time all yor trobols go vanish like wota wey dey flow pass and dem nor go remember am again.
wine wey go make us happy; olive oil wey go make awa skin good and bread wey go give us strent.
Strong drink na for pipol wey dey won die and wine na for doz wey dia heart heavy.
Make yu tok for doz wey nor fit tok for demsef; make yu judge well for doz wey dem dey opress.
Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind.