Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 31:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Lemuel, my pikin! E nor good make king dey drink wine and make rulers too, nor dey take strong drink.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 31:4
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Zimri, one among en ofisas wey dey kare for half of di king shariot, plan against am. One day for Tirzah, Arza wey dey kare for di palis, Elah go en house kon drink too mush for der.


Dem tell King Ben-Hadad wetin King Ahab tok for where en and en oda rulers sidan dey drink for dia tent. So e kon give en men orda sey make dem ready to attack di town, den dem divide diasef into group.


For di sevent day for di party, di king spirit kon high well-well bikos of di wine wey e drink, so e tell seven of en pesinal savant: Mehuman, Bigta, Harbona, Bizta, Abagta, Zetar and Karkas,


Just as di king kommand, dem kon tok evritin for di main town for Shushan and di messenjas karry am go evriwhere for di kingdom. Di king and Haman dey drink and enjoy diasef, while evribody for Shushan town, dey run up-and-down.


Too mush drink dey make pesin tok and bihave anyhow and pesin wey dey drink too mush, nor get sense.


Yu go bi like pesin wey sleep near river or on-top boat for wota.


Kountry wey en king get betta karata, wey en leaders dey chop for di rite time, so dat dem go get pawa and nor dey drink anyhow, na blessing go follow dem.


Una own don finish! Pipol wey bi champion for where dem for dey drink ogogoro! Dem dey get heart well-well wons e rish to mix difren drinks!


True-true, wine go disgrace proud and wiked pipol! Dia mout wide like grave and just as deat nor dey beleful, na so too nor-tin dey beleful dem. Bikos of dia long-trot, dem don gada nashons kon swallow many pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ