25 E dey strong; dem dey respet am and e nor dey fear wetin go happen for future.
I dey always do betta tin. Evritin wey I do dey always dey good.
If na so, stand up make yu ansa mi; dress like king make yu hail yorsef.
I go protet en priests and joy go full di heart of doz wey dey fear God.
Make yor glory kover yor priest; make joy full yor loyal savants heart.
Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.
Instead, make una wear Jesus Christ like klot for body. Den wi nor go do di tins wey awa body wont.
Den, true raitiousness and holiness wey di trut dey bring, make una wear di new man wey God don kreate like ensef.
Instead, make dem get good karata as wimen wey dey fear God, suppose bi.
I wont make wimen dey dress well with sef kontrol. Nor make yeye hair style; nor wear too mush gold or stones and klot wey dear well-well.