15 E dey kwik wake-up for morning to make food for en family kon tell en savants wetin dem go do.
God wey bi dia grand-grand papa God always dey warn dem, bikos E dey pity for en pipol and Jerusalem wey bi en house.
If na so-so sleep yu dey sleep, na poverty go kill yu. But if yu dey work hard, yu go get plenty food to chop.
E go-go look land kon buy am and e go use di money wey e get, take plant tins for der.
So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.
Make una remember wetin I dey tell una so, before dem go happen.
For early morning wen evriwhere still dark, Jesus leave di house go one kwayet place go pray.
Jesus ansa, “Who bi di manaja wey get sense and nor dey do wayo? Na pesin wey di oga put make e kare and give di oda savants dia food for di rite time?
Make una nor taya, but with di Holy Spirit help, make una serve God with betta mind.
As sun dey shine di next morning, Joshua and Israel pipol komot from Shittim go Jordan River. Dem stay der before dem cross di river.