10 Who go fit find wife wey get good karata? Good wife betta pass gold.
Wisdom get betta value pass diamond or fine glass.
Good wife dey bring joy and pride to en husband; but wife wey dey bring shame for en husband bi like diziz for en bone.
Wise woman dey build en house, but foolish woman dey skata en own with en hand.
Man wey find good woman kon marry am, don si good tin and God go favor and bless am.
Pesin fit inherit en papa and mama propaty, but na only God fit gi-am wife wey get sense.
To tok with wisdom, betta pass to get gold and silva.
Wisdom get value pass gold and e nor get anytin wey yu fit use take kompare am.
En husband go trust am, bikos di wife go support am for evritin wey e dey do.
Na mi bi wisdom; I betta pass gold; nor-tin una wont wey good each mi.
“Wetin I dey find since, I neva still si am; I si sey among 1,000 pipol, na only one man dey good, but I nor si any woman wey good among dem.
So Rut, make yu nor worry, I go do evritin wey yu ask for, bikos evribody for di village know sey yu bi good pesin.
Di man name na Nabal and en wife na Abigail. Di woman get sense and e fine well-well, but di man bad and na wiked tins e dey do. Na Kaleb tribe e from kom.