Afta dem don waka pass, Elijah kon tell Elisha, “Make yu tell mi wetin yu wont make I do for yu, before God go take mi go heaven.” Elisha ansa, “Abeg! Make yu let mi get doubol of di pawa wey yu get.”
Na only one tin I ask from God and dat na wetin I wont! Na make I stay for God house forever, so dat I go dey si en mighty works kon always dey happy for inside en temple.
Di first one na: Help mi make I nor dey lie and deceive pipol and di sekond one na, make Yu nor make mi too rish or too poor! Make yu give mi di tins wey go rish mi use.