“Man pikin, go warn Egypt king. Tell am dis message wey I dey give yu: “ ‘Yu bi lion among di nashons, but na ordinary animal yu bi for sea; Yu dey skata di wota with yor leg kon make di river dirty.
Doz wey remain for Israel go skata go oda nashons and dem go bi like lion among animals for bush; like yong lion wey dey mash and kill oda animals without who go save dem.
So for di sevent day, as evening dey rish, di men kon tell Samson di ansa sey, “Na wetin go fit dey sweet pass honey or wish tin or animal strong pass lion?” But Samson ansa dem, “If to sey, una nor work with my melu, una nor for know di ansa.”