Dem dey tell odas sey, “Make una nor near us, wi dey too holy for una to tosh! Doz pipol bi like smoke for my nose, bikos my vexnashon for dem bi like fire wey nor dey kwensh.
una still sey, ‘Wi neva do any bad tin at-all, so God nor go vex for us again.’ But make una look! I go make sure sey I judge una, bikos una sey, ‘Una neva kommit any sin.’
“So Jerusalem pipol, make una from una heart stop all di bad-bad tins wey una dey do, so dat una go dey save. Wetin make una nor fit stop to tink bad-bad tins?
God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.
Di Farisee kon stand dey pray about ensef sey: ‘God, I tank yu sey I nor bi like oda pipol wey dey play wayo, dey sin, pipol wey dey kommit adultery or even like dis tax kollector.
E kon save us. Nor bi bikos wi do good, but na bikos of en mesi. E forgive awa sins and E make us new shidren kon give us new life thru di Holy Spirit.
and from Jesus Christ, di witness wey dey tok trut; di first-born among doz wey God raiz from deat and naim bi di King of all kings. Christ wey love and free us from awa sins with en own blood;