Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 3:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 If yu do like dat, both God and human being go dey happy and favor yu.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 3:4
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But God dey with Josef kon show am as E love am rish and E make di pesin wey dey guide di prison, love Josef well-well too.


Na to obey God bi di rite way to get sense and evribody wey dey do wetin E tok, dey get sense and do well. So make praiz bi en own forever and ever.


God dey happy with good pipol, but E dey kondemn doz wey dey plan wiked tins.


Dem dey respet pesin wey get sense, but sturbon pipol go distroy demsef.


Doz wey find mi, go get life and God go favor dem.


So God kon make Ashpenaz mind soft and e gri with wetin Daniel tell am.


Jesus kon dey get sense more-more as e dey grow, so God and pipol like am well-well.


Dem kon dey praiz God and dey fellowship with one anoda. So God kon dey add more pipol join dem evriday.


If yu serve Christ like dis, God go dey happy with yu and pipol go respet yu.


Bikos wi dey try to do wetin dey rite, nor bi only for God eye, but for pipol eye too.


So God really bless Hannah and e kon born three boys and two girls. Samuel grow for inside God house.


So, Samuel kon dey grow and get favor from both God and pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ