35 Pipol wey wise go get good name, but fools go only add trobol join dia disgrace.
I go disgrace en enemies and David kingdom go rule forever.”
Yu dey guide and advise mi as Yu dey lead mi enter where glory dey.
Dem dey praiz pesin wey get sense, but nobody dey respet wiked pesin.
Doz wey dey fear God nor like lie; but na only shame and disgrace wiked pipol dey kause.
Rish pipol fit pay anytin for dia life, but nobody dey treaten poor man.
Love wisdom and e go make yu great; draw am near body and e go bring respet for yu.
Una wey nor know anytin, make una get wisdom. Una wey nor wise at-all, make una try get sense.
Den di pesin wey invite two of una go tell yu, ‘Get up make dis man sidan.’ Den with shame, yu go-go sidan for back.
“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!