Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 3:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Fear nor go katch yu wen yu dey sleep and yu go sleep well still day break.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 3:24
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, Jehoshafat kon get peace, bikos God dey protet am for evry side.


Yu nor go fear yor enemies again and pipol go dey kom beg yu for help.


Dem get mind and dem nor dey fear as dem dey fight and distroy dia enemies.


E dey yuzles to work hard from morning go rish nite, bikos of wetin yu go chop. Yes! God dey provide for di pipol wey E love, even wen dem dey sleep.


I dey rest, sleep and wake-up well, bikos God dey protet mi.


I nor dey fear, even doh doz wey dey attack mi from evry korna, plenty well-well.


I dey sleep with peace, bikos na only Yu wey bi my God, dey save mi.


So, make una nor fear di wahala for nite or di arrow wey dey fly for day time.


But anybody wey listin to mi, go dey save and e nor go get rizin to fear.


Obey God and yu go get long life; yu go dey happy and dey save from trobol.


Wetin dem tish yu so, go lead yu wen yu dey waka, protet yu for nite kon give yu good advise for day time.


Pipol wey dey work hard, dey sleep well for nite; weda dem chop small or plenty food. But pipol wey too rish, nor dey even fit sleep at-all.


Na raitiousness go make una strong. Una go dey save from pipol wey dey opress una and from doz wey dey kause wahala.


Den pipol go sey, ‘Wi sleep in peace and wake-up in peace.’ ”


Na mi mysef go bi dia shepad and I go give dem place to rest. Mi, God wey get pawa, don tok.’ ”


“I go make kovenant wey go guide and protet dem. I go distroy all di wiked animals for di land, so dat my sheep go fit stay for peace as dem dey di field and forest.


Dia tree go bear fruits; dia fields go bear betta plant and evribody go stay for peace for en land. Wen I don break di shain wey dem take tie my pipol kon free dem from pipol wey dey trit dem like slave, den dem go know sey na mi bi God.


I go give una peace for una land and fear nor go katch una wen una dey sleep. I go kill all di wild animals for di land and war nor go dey der.


But for di nite before dem go judge am, dem tie Pita with two shains and e sleep for two sojas centre. Oda sojas still dey di prison front, dey guide am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ