23 Dem go make yu dey save for anytin wey yu dey do and yu nor go ever fall.
Pipol wey love wetin Yu tok, get peace of mind and dem nor dey fear, shake or fall.
E nor go let mi kick stone fall; di Pesin wey dey guide mi nor dey sleep.
God dey always protet mi both wen I go out and wen I dey kom back! E go protet mi naw and forever.
Dem don make God law dia own, so dem nor go ever sin.
Pipol wey dey tok trut dey save and sikure, but wayo pipol dey waka enter trobol.
E dey protet pipol wey dey trit odas well kon guide doz wey dey respet am.
Nor-tin go stand for yor way if yu dey live wise life, den yu nor go fall wen yu dey run.
Wetin dem tish yu so, go lead yu wen yu dey waka, protet yu for nite kon give yu good advise for day time.
No one taya or stagga for road and dem nor stop to rest or sleep for road. Dia belt nor kut and dia sandal rope nor ever luz.
Dia leg strong for groun like horse wey dey run fast and dem nor fall, bikos God dey lead dem.
I go make my pipol strong and dem go woship and obey mi.” Mi, Oga God, don tok.