22 Dem go make yu live sweet and happy life. Dem go bi like betta shain for yor neck.
bikos wetin dem dey tish yu go bi like betta shain for yor neck and betta kap for yor head.
Wisdom bi like wota wey dey give life to wise pipol, but na waste of time to go tish foolish pesin.
Do good to yorsef kon learn evritin wey yu fit learn; den remember wetin yu learn and yu go prosper.
Make yu dey do good and tok trut and yu go get long life; den odas go respet and trit yu well.
Make yu always remember evritin wey yu don learn, bikos na wetin yu learn go give yu good life, so make yu guide am well-well.
Bikos dem dey give life and betta body to anybody wey undastand dem.
Doz wey find mi, go get life and God go favor dem.
My Oga God wey get pawa, yor kommand dey give pesin life; so make Yu give mi life again.
All dis nor bi ordinary word, but dem dey give life! Wen una obey dis word, una go get long life for di land wey una go soon cross Jordan River enter.”