God kon make difren trees make dem grow for di soil and dem dey good for food. (Naw, di tree wey get life, wey dey make pesin know tins well-well; wey dey good and bad, dey for di gardin centre.)
So God sey, “Naw wen man don bi like us, wen e don know wetin dey good and bad, make wi nor let am chop from di tree wey dey give life, if not, e nor go ever die.”
Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go allow am chop from di tree for God Paradise and dis tree dey give life.’ ”
E dey rush pass di town main road. For each side for di river, di tree wey dey give life dey bear twelf fruit and e dey bear one evry mont. Di leaf for di tree na to heal evry nashon for di world.