17 E go still make yor life sweet and yu go dey save.
Make wi praiz God! Pesin wey dey obey and love to do wetin God kommand, blessing dey follow am.
Yor word sweet well-well for my mout; dem even sweet pass honey.
Just as I dey happy to get propaty, na so too I dey happy to obey di laws wey Yu give us.
Pipol wey love wetin Yu tok, get peace of mind and dem nor dey fear, shake or fall.
My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi, bikos na yor laws dey give mi hope.
Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand! Si as I love dem well-well!
All doz wey dey keep God kommand and obey en laws, E dey show dem en faithfulnes kon lead dem with love wey nor dey fail.
Doz wey dey honbol, go inherit di land and dem go get peace kon prosper.
Wen pesin make belle sweet God, even en enemies go like bi en friend.
Yu go dey wise and di sense wey yu get go give yu happiness.
yu go happy, if yu remember and use dem well.
Oga God, Yu dey guide and save pipol wey dey faithful, bikos dem trust Yu.
I go give peace to evribody, both doz wey dey far and near! I go heal my pipol.
so lite go shine for di pipol wey sidan for darkness and where deat dey. Den God go give us peace.”
Since faith don make us dey good for God eye, wi don get peace thru awa Oga God Jesus Christ.