14 Undastandin get gain pass silva and e betta pass gold.
Na yor laws bi my special propaty; na dem my heart wont
Like pesin wey si many propaty karry for war, na so too I dey happy to hear yor word.
Yor kommand dey good to mi pass plenty silva and gold.
E betta well-well to get wisdom and undastandin, dan to get gold and silva.
Find am well-well, just as yu go take look for silva or oda good tins.
Anytin wey una get from mi, betta pass di gold wey fine pass and silva wey pure well-well.
Wisdom dey sweet well-well wen money dey, bikos both wisdom and money dey good well-well for dis life.
Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?
So I advise yu sey make yu buy gold; gold wey dem don polish with fire. Den yu go get plenty money. Make yu still buy white klot from mi kon wear am, so dat dem nor go si yor nakednes again, den buy medicine put for yor eye, so dat yu go fit si.