12 Bikos God dey korrect only di pipol wey E love, just as papa dey korrect di pikin wey e dey proud of.
Just as papa dey love and pity for en shidren, na so too, God dey good and dey sorry for doz wey dey fear am.
So Oga God, make di pipol wey Yu dey ponish, happy. Doz wey Yu dey tish yor ways.
Doz wey nor dey korrect dia shidren, hate dem. But doz wey love dia shidren, dey always korrect dem with love.
Korrect yor shidren and yu go dey proud of dem, bikos dem nor go make yu shame at-all.
Make una tink am well. Just as papa and mama dey ponish dia pikin, na so too di Oga una God ponish una for una own good.
Bikos na di pesin wey God love, na-im E dey korrect and E dey ponish all di shidren wey bi en own.”
I dey korrect and ponish anybody wey I love. So make yu dey sirious kon turn from sin kom meet God!