9 Wen wise pesin take foolish pesin go kourt, di foolish pesin go only dey shaut and tok anyhow, but e nor go dey happy.
E betta make wiked animal attack pesin, dan to listin to wetin foolish pesin dey tok.
If yu ansa yeye kweshon wey foolish pesin ask, den yu dey foolish, just like di pesin wey ask yu.
Pipol wey dey kill pipol nor like anybody wey dey tok trut, but good pipol go protet di pesin life.
Pipol wey nor get respet for odas, go fit kause konfushon for di whole town, but wise pipol dey keep tins to demsef.
and na only yeye tins fools dey tok and na madness dey end am,
“Make una nor give dog tins wey dey holy or trow yor gold give pig, bikos dem go mash am with dia leg, turn face yu, den kon tear yu to pieces.