Den Moses and Israel pipol bigin sing dey praiz God sey, “Wi go sing to God, bikos E don give us viktory. E trow di shariot and doz wey dey ride dem inside di sea.
True-true, nobody know di time wen dis tins go happen! Like fish wey net katch or bird wey enter trap, na so too, wahala just dey kom meet pipol by sopraiz.
Den dia sense go korrect and dem nor go fall enter devil trap again. Bikos devil don katch dem put inside en trap before, so dem dey do anytin wey e wont.