Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 29:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 With betta judgement, king dey make en kingdom strong, but king wey like money well-well, dey skata en throne.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 29:4
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

David rule evriwhere for Israel and e make sure sey dem trit evribody well with betta mind.


Solomon take-ova from en papa as king and God make en kingdom strong.


Make wi praiz di Oga wey bi yor God, bikos E like yu kon give yu dis en great kingdom. God love Israel and en pipol and E wont make dis kingdom last forever. E don make yu king ova dem, so dat yu go rule well and dey good with am.”


E go show yu sey wisdom get many side. Wisdom nor bi simpol matter. God nor even ponish yu rish as yor sin many rish.


Na raitiousness and justice Yu take make di foundashon for yor throne. Yu dey rule with trut and love wey nor dey fail.


Di king dey strong; E love to judge well. God dey make sure sey dem judge evry kase well. Na Yu make betta judgement and raitiousness dey for Israel land.


Wen pipol dey fear God, dia nashon go dey great, but sin na disgrace to evribody.


Di king dey tok with authority wey God gi-am, so make e make sure sey e dey judge well.


Make kings nor like wiked tins, bikos na korrect judgement dey make govment strong.


Wen king sidan for en throne dey judge, e dey fit know bad tin wen e si am.


If king dey defend poor pipol, e go rule tey well-well.


I dey help kings rule well kon make rulers give korrect laws to dia pipol.


God tell en pipol sey, “Wen di time don rish to save una, I go favor and ansa una wen una kry for help. I go guide and protet una kon make kovenant with evribody thru una. Una land wey skata and wey dirty bin full, I go klean am kon make una stay der again.


En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.


Anoda king go raiz wey go send en ofisas go opress pipol. Dem go kollect tax for dia hand kon make dia kingdom get plenty money. E nor go tey before dem go kill-am, but nor bi for publik or war.”


Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.


Den Samuel tell Saul, “Na foolish tin yu don do so o-o! Yu nor obey di kommandment wey di Oga yor God give yu. If to sey yu obey, God for make yu king for Israel forever.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ