Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 29:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Pesin wey get hot tempa dey kause kworel and pesin wey dey kwik vex, dey sin well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 29:22
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I curse dia wiked mind, bikos e too strong and dia annoyance, bikos e dey bad well-well. I go divide dem inside Jakob family kon skata dem among Israel pipol!


Na only trobol bad belle dey kause, but love dey kover evry sin.


Pipol wey dey vex anyhow dey do foolish tins and pipol hate doz wey dey deceive odas.


Pesin wey dey kwik vex, naim dey first kause fight; but kwayet pesin dey kwayet for evriwhere.


Pesin wey like to dey kworel, like trobol and If yu always dey karry body up, den yu dey kause wahala for yorsef.


Make yu nor make friend with pipol wey get hot and bad tempa,


Pipol wey like wahala dey kause trobol, just as mashes and kerosine dey start fire.


Just as iron dey make iron sharp, na so too, two pesin dey learn from each oda.


If yu give yor savant evritin wey dem wont from small kom, one day, dem go take evritin wey yu get.


Just as cream dey bring butter wen dem shake am and nose wey dem nak dey bring blood, na so too, to make pesin vex, dey kause wahala.”


Bikos where jealousy and long-trot dey, wahala and bad tins wey pipol dey do, dey der too.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ