21 If yu give yor savant evritin wey dem wont from small kom, one day, dem go take evritin wey yu get.
Abram still sey, “Since Yu neva give mi shidren, den one of my savants go inherit my propaty!”
To dey beat and korrect shidren, good well-well, bikos if dem dey do anytin wey dem like, dem go make shame katch dia mama.
Yu don si pesin wey dey tok anyhow? Even fools get hope pass am.
Pesin wey get hot tempa dey kause kworel and pesin wey dey kwik vex, dey sin well-well.
woman wey pipol nor like wey kon marry and savant girl wey kon take en madam pozishon.’
“Den di manaja tell ensef, ‘Wetin I go do naw? My oga won sak mi and I nor strong rish to dig and na shame for mi to go beg.
For der, one Roman soja get one savant wey e like well-well, but di savant nor well and e nearly die.
But if e just dey enjoy ensef anyhow for dis world, dat mean sey en spirit don die, even doh e still dey alive.