Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 29:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Wen wiked pipol dey rule, many bad-bad tins dey inkrease, but good pipol go dey alive to si di way doz wiked pipol go take fall.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 29:16
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem get mind and dem nor dey fear as dem dey fight and distroy dia enemies.


So make yu put yor hope for Oga God. Make yu dey always waka for en ways and E go honor yu wen E give yu dis land, den yu go si as E dey distroy wiked pipol.


but wen I look again, I si sey dem don die go! Even doh I look evriwhere weda I go si dem, I nor si dem again!


Pipol wey dey fear God go happy wen dem si wiked pipol dey fall. Dem go use wiked pipol blood take wosh dia legs.


Una go si am with una own eyes! Yes, una go si as God dey ponish wiked pipol.


My eyes don si my enemies dey fall and my ear don hear as God win doz wiked pipol.


Yor enemies go die trowey and all di pipol wey dey do evil, go skata.


God wey dey raitious know all wetin dey happen inside wiked pipol house and E go distroy dem.


Make yu show mi good ruler and I go show yu happy pipol. Make yu show mi wiked ruler and I go show yu pipol wey dey komplain.


Na who nor go fear and praiz yor name? Bikos na only yu dey holy. Pipol for evriwhere go kom woship yu, bikos dem dey si di good tins wey yu dey do.”


Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ