11 Stupid pipol dey show dia vexnashon for publik, but pipol wey get sense, dey-dey patient and kontrol demsef.
Foolish pipol dey kwik vex, but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.
Wise pipol nor dey karry body up, but foolish pipol dey show dia foolishness.
Wisdom dey follow pesin wey dey fear God; but yu nor fit si wisdom for where foolish pipol dey.
If yu get sense, yu go fit kontrol yor tempa. E dey good make yu nor ansa if pesin offend yu.
So, to keep kwayet for dis kind evil time, naim bi di best tin to do!
So make una nor trust anybody; even if di pesin na una best friend or wife!
so e tell am di trut at last. E sey, “Dem neva kut my hair wons, bikos wen dem born mi, dem dedikate mi give God as Nazirite. So if yu kut my hair, my pawa go leave mi and I go kon dey weak just like anybody.”